We dey welcom our OLS Resident Fellow, Seun Olufemi, to di OLS-9 Delivery Team

- Malvika, Seun Elijah

David Rotimi (CC BY-SA 4.0)

This blog is written in Nigerian Pidgin, and is also available in English.

We just announce di ninth cohort - OLS-9 - for our Open Science training and mentoring program wey we dey call Open Seeds. For dis cohort, we don create new role, Resident Fellow. We announce am with invitation for application from facilitators (dat is, people wey dey already help run dis program).

We really appreciate all di people wey apply and wey present strong project plans and share dia vision for dis role. As we fit only offer one position, we choose di person wey dia project goals fit well with wetin di OLS team fit do to support dem for di next eight months as part of di Open Seeds OLS-9 plans.

We dey happy to announce say Seun na im we choose for dis OLS Resident Fellow role!

Seun go work with Malvika Sharan and Tajuddeen (Taj) Gwadabe as part of di OLS-9 delivery team.

A photo of Seun, a man from Nigeria. Him wear big smile and African round-neck shirt.

A Biochemistry Researcher and Champion of Open Practices

Seun na Biochemistry graduate from Ladoke Akintola University of Technology. Im dey passionate about how disease dey start for di body (molecular pathogenesis) and how to develop drugs to stop am. Im also be strong champion for digital skills and open science. Im dey work as Graduate Research Intern for Institute of Human Virology, Nigeria, wia im dey study how disease dey spread for di body at the molecular level. E also be Research and Teaching Assistant for Helix Biogen Institute, wia e dey support research wey dey take scientific findings and turn am to something wey people fit use (translational research) and training for bioinformatics and vaccine design. Even though Seun still dey early for im career as researcher, im don already publish eight peer-reviewed articles.

Seun Dey Wear Many Hats for Open Science

As e dey committed to improve bioinformatics and open science skills for Early Career Researchers for him community, Seun dey contribute to many initiatives. As person wey benefit from OLS Open Seeds before (Cohort 7), im co-found Bioinformatics Outreach Nigeria project to solve di problem of no training for bioinformatics for Nigeria and to mobilize many young scientists wey go embrace in open science.

E recently don become PREreview champion and ASAPbio fellow (2024) wey dey try make sure everybody get access to knowledge from research wey dem never publish yet. E also serve as hub champion for di Catalyst program for him region and go support him network to engage with di OLS-9 Catalyst Track wey Taj dey lead.

Resident Fellowship to Build Community Leadership Capacity

Seun work for OLS go focus on how to manage and lead a community as im continue to lead and grow di Bioinformatics Outreach Nigeria Project with people for im community. Malvika go mentor am and im go connect with di whole OLS team, wey go give am chance to learn about all di different things wey di organization dey do.

Im Resident Fellowship go cover two parts for OLS:

  1. Because im dey part of di OLS-9 Delivery team, im go get experience on how dem dey organize training for whole communities. Im go work with Malvika to coordinate di OLS-9 DRI-EDIA Track.
  2. E go get special one-on-one training and support to build skills and knowledge wey go help am spread di skills of bioinformatics and open science to im local communities. Specifically, dem go support am to change di Open Seeds training materials to fit im community and connect am with di whole network of open science people.

Join us as we welcome Seun!